Four African girls don create generator wey fit use wee-wee “Urine, that is” to produce electricity. One litre of wee-wee go produce 6-hour supply of electricity.
Dem showcase the generator for Maker Faire in Lagos, Nigeria, a week ago.
The girl-innovators are teens Duro-Aina Adebola, Akindele Abiola, and Faleke Oluwatoyin, all age 14, and Bello Eniola, 15.
No ask me how the thing go work. Go find the girls.
But Yahoo News fit help small:”
- Urine is put into an electrolytic cell, which separates out the hydrogen.
- The hydrogen goes into a water filter for purification, which then gets pushed into the gas cylinder.
- The gas cylinder pushes hydrogen into a cylinder of liquid borax, which is used to remove the moisture from the hydrogen gas.
- This purified hydrogen gas is pushed into the generator.
And as for delivering the fuel itself? Well, we’ll leave that up to the consumer.”
Hoping the right quarters go pick this up.
Abeg 4 heaven sake, wetin we dey do wit dis kind inovation? Na dis kind things we dey talk say dem scArce 4 our country. Now wey dem D̶̲̥̅̊ø̶̷̩̥̊͡ñ̶̷̩̥̊͡ dey hApen, shey na only 4 news we go read A̶̲̥̅♏? Make we find way †̥☺ dey synthesize urine 4 our labs §ø̲̣̣̥ we go fit dey manufacture dis cost efective *nd carbon free dynamo plenty plenty. …abeg make some person do sth….anything…make dem n̶̲̥̅̊o̶̲̥̅̊ just alow dem afrikan scientists enter oblivion or make dem n̶̲̥̅̊o̶̲̥̅̊ alow oyinbo peopl com ship dem abroad.
I tire o.
U think we need synthesize urine, in spite of all the ones wey we dey urinate every day?
People wey dey wee-wee nko, we fit pack dem yansh to dey collect dem urine na.
Meanwhile, bro I like your Pidgin, no be lie!