lAkUnLeScReWs don gather from reliable source – that one na saharareporters, say Chief Oluwole Awolowo, wey be the second son of late Yoruba sage Chief Obafemi Awolowo don peme, that is die. The guy die today afterem sick small. Na so em sister, Tokunbo Awolowo, yarn am.
We confirm say Mr. Oluwole die for one London hospital where em don dey receive treatment.
Please, note say na this guy be the publisher of Tribune Newspapers.
Em age na 70.
Make Baba God kukuma bless hin soul.
Na the thing wey em need be that. In fact ehn, na wetin we all need.