E don happen, Monopoly, that popular Board game. E don get Lagos city version now. All the Oyinbo dem English places like Liverpool, Travalgar Square, Mayfair everything don change to Lagos names. This one na the original Naija way of playing Monopoly. Na now you dey talk. Globalisation, na so e be… This na the first of em kind for an African city and na Lagos dem launch am, with Banana Island replacing Mayfair.
Murtala Muhammed International Airport e dey there. Makoko, the slum, dey there too. The Nigerian Stock Exchange and other properties dey on the board.
E get some other notable landmarks like the Tinubu Square, the New Afrika Shrine nightclub, Continue reading Lagos gets em own Monopoly version with Makoko as Mayfair etc.


