Tag Archives: Bukky Wright

Injustice against a drug man, addict, dealer, pusher or just a druggist

movies-001

 

RADIO SHOW:   Good Morning Naija

STATION:             MeroëRadio

TIME:                    25 hours G.M.T. every single day, no be small thing

Today’s Issue:    Injustice against a drug man, addict, dealer, pusher or just a druggist

I welcome you to another episode of the radio show, ‘Good Morning, Naija’ on MeroëRadio. This episode go bam. We wan focus small on wetin dem dey call Injustice as the thing recently affect one small part of an ogbonge profession of we country, Naija. That profession na Pharmacy.

Wetin dem dey call injustice?

According to Oxford Advanced Learner’s dictionary, injustice na “the fact of a situation being unfair and of people not being treated equally.”

So, wetin concern us for this matter sef; injustice, pharmacy? Well, me sef no know o. All wetin I know na say e get one Pharmacy like that wey dem dey call HealthPlus. Na the magodo branch for Lagos the injustice happen. And na against the Pharmacist wey dey work  for there e happen.

The antenna of MeroëRadio, na em catch the news on Sunday, 2nd December, 2012. The antenna see robbers, daredevils, as dem dey enter the Magodo Continue reading Injustice against a drug man, addict, dealer, pusher or just a druggist