Forget Me Knot gold ring na em the Icelandic fashion designer, Sruli Recht call em piece of luxury jewelry. The artist had a strip of his own skin surgically removed and mounted on a 24-karat-gold band.
One kind company, The Fertility Institutes don dey customize babies wey get special attributes or edge.
Dem claim say we never see anything and say plenty trips still dey on the way as science dey improve.
But some countries dey vex say “this is against moral and ethical practice”.
Whether you like am or you no like am, these designer babies don land.
You wan a baby wey dey black, very black or white, very white? Or shey na baby wey fine, beautiful, handsome, mildly handsome or gruesomely handsome? Now, you fit get am!
Which kind baby you want? Dan Foster kind?
Tu Baba (so “Nothing dey happen”)
or D’banj (for the Oyato thinzzz)
Well, you fit even like to get C. Ronaldo kinda baby right?
CR7
Whatever kinda baby wey you want, you fit customize am before the thing get inside em mama belle.
Liu Xianping, 72 don become model for ladies’ clothes to promote em granddaughter’s clothing store, Yuekou.
Baba got beautiful legs, no?
“Why unacceptable (for someone like me to wear women’s clothes? Modelling for the store is helping my granddaughter and I have nothing to lose. We were very happy on the day of the shooting. I’m very old and all that I care about is to be happy.”
Business don better for em granddaughter since Baba start modelling. Chop up!